Port Harcourt, Kano, Kampala Ranks The Most Polluted Cities - BBC NEWS

  • Weekly Giveaway for our active users. N50,000 per Week. Do you want to contribute to this community? We are looking for contribution? What is hot right now? Sign up and get in on the ground floor of the newest, fastest growing Nigerian forum!

Godspower

Well-Known Member
Apr 21, 2020
463
296
63
28
Kano na di most polluted city for Africa - Report
07 November 2019
Share Dis Tin With Email Share Dis Tin With Facebook Share Dis Tin With Twitter Share Dis Tin With Whatsapp
Kano
One report tok say Kano na di most polluted city for di whole of Africa and di pollution reach 53.4% inside 100%.

Regarding wetin cause Kano to get dis kain unwanted mention, di report say dem use majorly three things.

Most pipo for di state dey use Firewood, Kerosine or charcoal to cook food
High number of refuse dumps and farm wastes
Smoke from cars, motorcycles and oda things.

Di report also add say na Kampala, Uganda be second to Kano for pollution followed by Port Harcourt and Addis Ababa wey come fourth.

Kano goment ban all ‘torture houses’ for di state
Kano zoo lion wey escape chop all di goats finish
Di report wey IQ Airvisual wey dey Switzerland release also put Nigeria as overall 10th for di world in terms of pollution.

Kano, Kampala, Port Harcourt and Addis Ababa na dem dey top of di list
Dem say Nigeria pollution level reach 44.8% for inside 100% and na Uganda and Ethiopia be second and third for Africa.

IQ Airvisual say Africa dey lack modern methods of checking and assessing information about pollution and dey face one of di biggest risks about pollution.

Di report also say Africa get di fastest rising cities for di world and because dia population dey als o increase wella na im make dem dey among reasons for di pollution.

Di report say na Bangladesh get di worst air to breath for di world followed by Pakistan and India.
 
  • Like
Reactions: Edwin sylvester